"EVERYDAY GRINDING"
Sleepless night.
Sleepless night, dem.
Sleepless night upon sleepless night—yes, I know.
Still, I no be vampire.
If no be your grace wey big pass my papa parlour,
How I for take live?
Many locations dey to run this stuff,
But trust me—your own na forever.
Forget all the rant… Baba, na you forever.
Do am for me.
Do wetin you do for Job.
Run am for me, Baba.
Single? Yes, I dey search.
But na the paper I wan toast—like my daily bread.
Everyday grinding… be like tomatoes.
Brokenness? Yes na the highest form of fever.
E dey kill like the faith of innocent mosquito.
Life be like ashawo—
Without money, you no fit run am.
On God. On God.
I be wan tire to talk am.
I be street boy.
So I go try secure the future.
Delay go dey,
But trust me, e go come.
Keep your plenty love—
Na money I suppose dey count.
Truth be told…
Love die with Baba Moses for mountain.
Dem dey enter my DM
With fake promise—as if dem be Promise Keeper.
No send me message,
If you no go talk about the paper.
Money dey stop rubbish,
And still dey bring many fake friends.
If you like, no pin am—
Me? I dey go my next poem.
Make everything dey—
Before dem go regard you.
My former serious babe?
Na another guy take am.
Sure!
Who no get money,
Conji no suppose dey worry am.
Fúnmi again.
Every poem—we go run am.
This is Fúnmi giving you wisdom.
This is more than a poem.
-
Author:
Fumilayo bayo (Pseudonym) (
Offline) - Published: November 26th, 2025 00:19
- Comment from author about the poem: Poem written in Nigeria pigin.
- Category: Unclassified
- Views: 1

Offline)
To be able to comment and rate this poem, you must be registered. Register here or if you are already registered, login here.